National Drug Law Enforcement Agency, NDLEA don declare suspended DCP Abba Kyari wanted ontop accuse say e belong to drug cartel.

National Drug Law Enforcement Agency, NDLEA don declare suspended DCP Abba Kyari wanted ontop accuse say e belong to drug cartel.

NDLEA tok for press briefing on Monday February 14, say di former Commander of Intelligence Response Team (IRT) na member of one drug cartel wey dey operate di Brazil-Ethiopia-Nigeria illicit drug pipeline.

According to NDLEA, Kyari faliure to cooperate na im make dem come out for public to do di press briefing.

"Unfortunately, some law enforcement agents wey suppose be partners for di pursuit of di president mandate dey front of breaking di law, as dem dey aid and abet drug trafficking for di kontri.

Today, we dey forced to declare one of such law enforcement agents wanted in di pesin of suspended DCP Abba Kyari, di former Commander of Intelligence Response Team (IRT) for di Force Intelligence Bureau of di Nigerian Police Force.

With di intelligence wey dey our hand, di Agency believe strongly say DCP Kyari na member of drug cartel wey dey operate di Brazil-Ethiopia-Nigeria illicit drug pipeline, and e need to ansa questions weycrop up in one ongoing drug case wey e be principal actor. " E tok.

Comments

Popular posts from this blog

How We Killed My Wife’s Friend, Sold Her Head For N70,000 – Man Confesses In OgunThe couple, Kehinde Oladimeji, 43 years and his wife Adejumoke Raji (35), were paraded on Monday at the Ogun State Police Headquarters, Eleweran, Abeokuta.

KINGSLEY UGOCHUKWU EKWURUKE ISMN DROP ABIA STATE HOUSE OF ASSEMBLY AMBITION, EMPOWER HIS COMMUNITY AND CALL FOR SUPPORT TO IKUKU OMA ABIA

Government is ready and willing to support initiatives that would create wealth ~ Professor Yemi Osinbajo